HAVE SOME LAUGH... BAD MARKET!!!

::;BAD MARKET:::;

Bad Market is when you go in front of White Garment Church to sell shoe or slippers, I ask you, Cele- church dey wear shoe....

Bad Market is when yu dress to go church come wear PINK top with BLACK skirt/ trouser, but as you
bounce enter church, you come see say na dat your colour una Church Choir wear dat
sunday. As you come siddon for back, pple come dey look you as
one Choir member wey dey under
suspension....

Bad Market is when you chop the only fish head (isi-azu/ ori-eja) wey remain for pot
of soup, without
knowing say na that fish-head your Malleh wan take arrange nite-food for your
Palleh.... My dear, na that nite your Papa go disown if you no vomit that fish-head....

Bad Market is when a lady dey sleep come dey dream where she dey give birth for hospital bed. The
nurses come dey tell her pussssssssh, she just dey push dey go. When she finally
woke up, she come
see say na shit she dey shit for bed....

Bad Market is when you as a guyman, ask a girl to give you her number after toasting her, she come give
you her papa number. You come decide to call her at midnite for romantic chat... My
dear your name go
turn to "error in connection"....

Bad Market is when you don arrange your room finish, come lie down on top of bed dey wait for one chikala wey you invite to your house. As you hear knock on, na so you rush as sharp guy go open door thinking say na your latest chikala, you come
see say na your Landlord wey you dey owe 14months house rent....

Bad Market is when you mistakenly use weed (igboleaf) cook jellof-rice thinking say
na scent leaf or curry
leaf... My dear, na Fela or Bob Marley go wake you up for New York when you eat the
rice finish....

Bad market is when you as a babe, follow guy go joint, you just dey chop every every, infact all the
gbogbontigbo na your belle e enter, isiewu, point and kill, cowtail and gaot meat pepper
soup, peppered snail, fried peppered meat, fried peppered gizzard and fried peppered turkey,...you even drink red wine,
akpeteshi, opaeyin, odeku, palmwine, sapele water, infact ehn, you just guzzle
everything down, the guy sef pay, una come enter room you come dey form for the guy say yu dey do menses,
omo na their you go
sabi say gobe dey get gator.

Bad market is when you do runs for school, enter party wen be say dem don
organise sugar daddy/
mummy wey dey wait you for inside room, you enter the room after you don manya
sotey your eye don
dirty but as you just enter the room, na your palleh/malleh be the sugar daddy/
mummy wey dem arrange you for. Hmmm e don red 4 u be that....

Bad market is when you find yourself in Aluu on a friday morning, stealing a glimpse at a pretty
babe.....mehnnn na Aluu5 dey load for your neck be that because na you dem go take complete am Aluu5....

Bad market is wen yu just catch a new hot babe, while on date wit her, u con cari her enta one eatery, na dat tym u con realize say ur newest designer shirt wey yu wear na im be d material wey dem take do dia own table cloth.....Lol

...Oya knack us your own idea of Bad Market nd lets make it fun..

‪#‎Winkz‬#..

Comments

Popular posts from this blog

“I love Falcao and Cavani” – Wenger

We are not part of Lagos APC – APGA

ASUU strike update: Don’t send your children to school, we won’t teach them – Lecturers warn parents